Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 9:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Doz wey dey sin among my pipol, dem go kill dem for war; pipol wey bin sey, ‘God nor go allow anytin bad happen to us.’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 9:10
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”


Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do, so dat wi go si. Make Israel God wey dey Holy do wetin E plan, so dat wi go know.”


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


Pipol wey nor gri listin to wetin God tok, dem dey tell dem sey, ‘Evritin go-go well with una!’ And dem dey tell sturbon pipol sey, ‘Bad tins nor go happen to una at-all!’


Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol. Mi, wey bi God, don tok.”


Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”


E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion and una wey feel sey una dey save for Samaria. Una tink sey na una strong pass, bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.


Una nor won gri sey wahala dey kom and wetin una dey do, go make am kwik kom.


Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.


Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


Naw, wi dey sey, na pipol wey dey karry body up, happy pass. Wiked pipol nor dey only prosper, but dem dey test as God patient bi with di wiked tins wey dem dey do; yet nor-tin dey happen to dem.”


Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ