3 “For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
So, dis na wetin God tok about Josaya pikin, King Jehoiakim for Judah: ‘Nobody go mourn wen e die or tell en neighbour, “My friend, di king deat dey vex and pain mi!” Nobody go kry for am sey, “My oga and my king don die!” ’
Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!
Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.
“I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.
So God wey get pawa sey, “For di town, pipol go dey kry and mourn for evriwhere. Dem go sey make farmers kry for dia land, den dem go pay pipol wey go kom mourn with dem.
Oga God wey get pawa don warn una well-well sey, “I hate as Israel pipol proud rish; I hate di strong and big-big house wey dem get. I go give dia main town and evritin wey dey inside, to dia enemies.
“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.
Dem dey ready to kill. Dia swod and spear dey shine as dem dey kill pipol for evriwhere. Nobody fit kount di pipol wey dem kill and doz wey remain dey run fall on-top di dead body dem.
So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.