Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 8:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Di time dey kom wen I go send honga kom di land. Pipol go dey hongry, but nor bi for food. Dem go dey thirsty, but nor bi bikos of wota; instead dem go dey hongry to hear God message.” Oga God don tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 8:11
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For sometaim naw, Israel pipol nor get di true God or priest wey go tell dem di law or wetin to do.


Naw, wi nor dey si yor mirakles again. All di profets don die and nobody fit tell us wen dis wahala go end.


Wen pipol nor follow God way, dem dey waka anyhow, but pipol wey dey obey God law, na happiness bi dia own!


I go let grass grow for evriwhere and I nor go trim di vine or use hoe dig di groun again, instead, I go let dirty kover am and rain nor go ever fall put again.”


One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.


If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.


So, na only darkness una go dey si and una nor go get any vishon. Darkness go kover una kon end evry hope wey una get. Sun nor go shine for una profets head again a nd una life go end like dat.


Wen e si how pipol plenty rish, e kon sorry for dem, bikos nobody dey to help dem and dem kon dey waka anyhow like sheep wey nor get who dey look dem.


Samuel kon tell Saul, “Wetin make yu dey disturb mi? Wetin make yu koll mi kom back?” Saul ansa, “I dey for big wahala! Filistia pipol dey fight mi and God nor dey ansa mi again. E nor dey listin to mi or tok to mi thru profet or dream. So I kon koll yu, so dat yu go tell mi wetin I go do.”


So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.


Samuel kontinue to serve God under Eli di priest and for dat time, God nor dey too give dem message or vishon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ