8 E kon ask mi, “Amos, wetin yu dey si?” I ansa, “Na ruler.” Den E sey, “I go test my pipol with dis ruler. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.
Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.
Gomer, Hosea wife kon born anoda pikin, but dis time, na girl. Den God tell Hosea, “Yu go koll dis one, ‘Lo-Ruhamah wey mean: No-pity,’ bikos I nor go show Israel pipol love or forgive dem again.
God kon ask mi, “Amos, na wetin yu dey si?” I ansa, “Na basket wey fruit full.” Den God tell mi, “Di end don kom for my pipol, Israel. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.