Elijah komot from der kon si Elisha, wey Shafat born, dey work with twelf melu for en farm. E sidan on-top one, while eleven dey en front. Elijah remove en own klot kon use am take kover Elisha body.
Den di profets sons wey dey Bethel kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?” Elisha ansa, “Yes! I know, but make una kwayet.”
Den di profets sons wey dey Jeriko kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?” Elisha ansa, “Yes! I know, but make una kwayet.”
Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”
Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.
Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel.