Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
Na white and blue curtain wey dem tie with fine purpol linen with silva ring and betta stones, dem take dekorate di kourtyard. Dem put tins wey dem make with gold and silva, for di kourtyard groun wey dem design with white, red, blue and black stones.
But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”
Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.
“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
Oga God sey, “Na only few pipol for Samaria go eskape with dia life and with small piece for dia bed and chair. E go bi like wen shepad save two leg and some part of en sheep ear from lion mout.”
“For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”