Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 6:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Una nor won gri sey wahala dey kom and wetin una dey do, go make am kwik kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 6:3
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


Yu sey, ‘I go bi kween forever.’ But yu nor tink about dis tins or tink about wetin go happen.


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


Pipol wey dey chop betta food before, don turn who dey beg food for street. Pipol wey dey wear fine and betta klot before, don turn who dey wear rag naw.


“Man pikin, wetin make Israel pipol dey always tok like dis: ‘Di days dey pass dey go, yet all dis vishons nor mean anytin to dem?’


“Man pikin, Israel house dey sey, ‘Di vishon wey God dey tell us nor go happen naw; E dey tok about tin wey go happen tumoro.’


Pipol wey nor kare dey der dey shaut and na wildaness dem from bring dis pipol. Dem put shain for di wimen hand kon wear betta crown for dia head.


God sey, “Propaty wey dis pipol use wahala and wayo get, na-im dem pak full dia house and dem nor even dey tok trut or do wetin dey rite.”


Go tell di pipol wey dey stay for Egypt and Ashdod palis sey, “Make una gada round di hills for Samaria! Make una si di wahala wey dey happen for di town and di bad-bad tins wey dem dey do.”


Una sin and all di bad-bad tins wey una do, I know as dem bad rish. Una ponish good pipol; dey take bribe and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.


E go bad well-well for una wey dey wait for God day! Wetin make una dey wait for dat day to kom? Instead make di day bring lite, na darkness go kom.


Horse fit run well on-top rock? Abi human being fit ride horse on-top wota? Yet, una don turn bitter judgement to poizin and good to bad.


Doz wey dey sin among my pipol, dem go kill dem for war; pipol wey bin sey, ‘God nor go allow anytin bad happen to us.’ ”


Di rish pipol among una dey get more money thru wayo and wikedness. Una pipol don too good with lie and trut nor dey dia tongue again.


But if na wiked savant, e go tell ensef, ‘My oga nor go kwik kom back’,


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Dem go sey, “I tink sey Jesus promise sey E go kom back? Awa grand-grand papa dem don die since, but evritin still bi as dem bi since God kreate di world.”


Bikos na only one hour God take distroy dis big town finish!” And evry ship, dia kaptain and pasenja, plus evribody wey dey work for sea, go stand far,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ