2 Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
Dis na wetin God tok about Damaskus: “Di pipol for Hamat and Arpad town dey worry and dem nor get rest, bikos dem hear bad news. Dia mind dey trobol dem like river and dem nor fit rest.
As e dey tok to dem, Goliat di Filistia champion wey kom from Gat kon kom out from Filistia pipol side. E tok as e always dey do and David kon hear am.
So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?” Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.