My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
But with evritin wey I tok, una plant wikedness kon harvest wetin una plant. Una don chop di fruit wey una lie-lie kause. Bikos una trust una shariot and di many sojas wey una get,
Na empty words dem dey tok kon dey give lie-lie promise and naw, just as dem turn field wey betta plant suppose grow to where poizin grass full, na so too dem don turn betta judgement to bad one.