Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 5:8
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E open all di sekret tins wey dem hide for darkness kon put lite for where deep pass.


God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.


Yu fit kommand di kloud kon sey make rain bigin fall?


Na God make di Bear, Orion, di Pleiades and di sky for sout.


God dey bring darkness and nite kom and na dat time, wiked animals for di forest, dey waka.


God kover Egypt with darkness, bikos dem nor gri allow en pipol go.


I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.


and wi dey waka anyhow like blind pipol. Wi dey fall for aftanoon and for nite; e bi like sey wi dey dark world, for where dead pipol dey.


Den God sey, “So, I go make dis wiked pipol know my pawa and how I strong rish and dem go know sey na mi bi God.”


Na mi, God do dis tins! Na mi God, make di eart kon put am for where e dey so. Dem know mi as Oga God; naw I dey tell yu,


“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”


For dat day, I go make di sun vanish for aftanoon and darkness go dey di eart for day time.” Oga God don tok.


God build en house for di heavens and put di foundashon for dis eart. E draw di wota wey dey di sea kon pour am for di eart. En name na God!


una wey dey darkness, don si big lite and una wey don nearly die, don get life.”


so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness and where deat dey. Den God go give us peace.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ