God go shake Israel land like wood wey dey float for wota. E go rut Israel pipol komot from dis good land wey E give dia grand-grand papa kon skata dem pass Eufrates River, bikos dem don make am vex as dem make Asherah juju kon dey woship am.
Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.
For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.
“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”
E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion and una wey feel sey una dey save for Samaria. Una tink sey na una strong pass, bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.