Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
God wey get pawa sey, “Una wey bi ruler for Israel, na since una dey sin! Make una stop una wahala and opreshon. Make una dey do di rite tin. Una nor go ever drive my pipol komot from dia land again. Na mi wey bi Oga una God dey tok so.