Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.
Bikos Oga God go waka pass Egypt kon kill pipol, but wen E si di blood for di up and two side for una door, E go waka pass and E nor go enter una house kon kill una.
Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.
“Den, Israel pipol, una go know sey na mi bi di Oga una God. I dey stay for Zion wey bi my holy hill. Jerusalem go bi holy town and strenjas nor go fit win am again.
So Israel pipol, dis na wetin God tok: “Even doh Assyria sojas get pawa and dem many well-well, I go distroy and skata dem finish for dis world. My pipol! I know sey I don ponish una before, but I nor go ponish una again.
Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.
Den I go surround and guide my temple both for back and front. I nor go allow wiked rulers opress my pipol again, bikos naw, I don si how my pipol sofa rish.”