Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 5:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 5:15
42 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”


En ofisas go meet am sey, “Wi hear sey Israel pipol kings dey show mesi. Make wi wear sak klot go meet am; may bi e nor go kill yu.”


King Jehoahaz nor get any sojas, escept fifty men wey fit use horse, ten shariot and 10,000 sojas for groun. Siria king don kill and mash all en men like san-san.


Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”


Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins.


Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good. Make yu dey leave for peace with evribody and do evritin to keep am like dat.


Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.


So, make yu turn from bad tins kon do good and yu go stay for di land forever.


Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine


Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.


Di next day, Moses tell di pipol, “Una don kommit sirious sin; but naw, I go-go meet God, may bi E go fit forgive una.”


and dat nashon stop to dey disobey mi, I nor go do wetin I bin sey I go do.


Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.


God even sey, “Make una sing and happy for Israel pipol; make una happy for di nashon wey great well-well. Make dem hear una praiz for evriwhere kon sey, ‘God, make Yu save yor pipol, diliver Israel pipol wey remain.’


God wey get pawa sey, “Una wey bi ruler for Israel, na since una dey sin! Make una stop una wahala and opreshon. Make una dey do di rite tin. Una nor go ever drive my pipol komot from dia land again. Na mi wey bi Oga una God dey tok so.


Daniel beg di king make e promote Shadrak, Meshak and Abednego, so dat dem go dey handle some issues for Babilon. Daniel, ensef kon dey serve for di king palis.


Who know weda di Oga una God go shange en mind kon bless una with many-many food. Den una go offa korn and wine gi-am again.


Una nor like anybody wey dey judge well or tok trut for kourt.


Instead, make korrect judgement dey rush like river, while raitiousness go bi like river wey nor dey dry.


So, make una go meet God and una nor go die. If una nor go meet am, E go kom on-top una like fire. Di fire go burn Bethel pipol and nobody go fit kwensh am or save una.


Horse fit run well on-top rock? Abi human being fit ride horse on-top wota? Yet, una don turn bitter judgement to poizin and good to bad.


So God shange en mind kon sey, “Wetin yu si, nor go happen again.”


Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”


May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”


“One day, I go gada Israel pipol; I go gada di ones wey remain, just as dem dey gada animals for farm. Yes! Pipol go plenty kon dey make nois for una land again!


but na una even hate good tins kon love wiked tins. Una dey kill my pipol alive kon kut dia flesh from dia bone.


God go give Israel pipol to dia enemies until di woman wey dey labor go born. Den en own kountry pipol go kom back to dia land from Babilon.


Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.


Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”


Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.


I dey like to obey God law with my whole mind,


Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.


My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ