Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 4:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So pipol dey stagga from one town go anoda town go look for wota wey dem go drink, but dem nor si enough wota drink and with all dis tins, una nor still gri turn from sin kom meet mi.” Na so Oga God tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 4:8
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Ahab tell Obadaya, “Make yu go all di land; pass thru di wota and di valley kon shek weda yu go si any aria wey grass dey, so dat di animals go-go chop for der, make dem nor for die.”


Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.


Bikos of dis, God nor allow rain fall, even for di rite time. With all dis tins, una still dey live una ashawo life and shame nor dey katch una.


I tink sey afta dem do all dis tins finish, dem go kom back kom meet mi, but dem nor kom and dia sista Judah, wey nor dey faithful too, si wetin dem do.


My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.


But dem nor gri kom back kon meet mi and bikos of dat, dem must go back to Egypt and Assyria pipol go rule dem by force.


Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.


God sey, “Na mi make hongry dey una town, but una nor still gri turn kom meet mi.


Even wen una chop, e nor go ever beleful una and una go still dey hongry like sey una neva chop at-all. Even doh una dey try to save money, e nor go mean anytin for di end. Una go save small, but I go gi-am to doz wey go distroy una.


Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.


Even wen I send hot breeze and big-big stones kom skata evritin wey una plant, una nor still gri turn from sin kom meet mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ