E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”
Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”
So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.”
My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.
Anytime I dey strol outside di town, doz wey dem kill for war, na dia dead body I dey si for road and wen I enter di town, I go still si sey pipol dey die, bikos dem nor si food chop. Profet and priest dey do dia work, but dem nor know wetin dem dey do.”
My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.
Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.
For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.