Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 4:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Bread wey dem make with yist, una dey bring am as ofrin to take tank mi and dey karry body up bikos of di oda ofrins wey una give. True-true, dis na di kind tin wey una like to do.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 4:5
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.


Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.


E sey, “Una sakrifice nor mean anytin to mi. I don taya for una animal ofrin; I nor like una goats, bull or melu blood.


Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?


Una dey tif; kill; dey sleep with who una nor marry; dey lie; dey swear; dey offa sakrifice give juju and dey woship gods wey una nor know before.


“Israel pipol, make una stop to celebrate una festival like doz wey nor know God. Una don turn from una God and nor dey faithful to am again. Una don sell unasef give juju like ashawo wey dey di land and una love wetin una tink sey love una.


God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.


Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.


God sey, “I hate di juju feast wey una dey do; I nor fit bear dem!


Wen una bring korn and burnt ofrin kom give mi, I nor go asept am; I nor go asept di animals wey una kill kon offa give mi as ofrin.


and di woship wey dem dey give mi, dey yuzles, bikos dem dey tish tradishon wey human being get.’ ”


“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one.


“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ