Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dem go drag una kom out from di small hole wey dey una wall kon karry una go Harmon land.” Na so Oga God tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 4:3
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.


As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.


Wen dat day go rish, pipol go karry di gold and silva juju wey dem make for demsef kon trow and abandon dem give rats and bats.


Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.


Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.


“Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.


Break di wall open as dem dey look yu kon trow yor load pass am.


So, na una dem go first katch as slave. And all di food, drink and party wey una dey do, go end.


Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.


Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?


Gilead pipol dey for Jordan River east, while Dan pipol dey near di sheep. Asher pipol nor gri komot from di wotaside, dem dey stay near di river.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ