Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 3:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So na who nor dey fear if lion dey shaut? God wey dey mighty don tok, na who nor go tok about am?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 3:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So my pipol Israel, wey dem mash for groun like flower, na di good news wey I hear from God wey dey lead heaven sojas, I don tell una so.


True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.


But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.


Den I sey, “Na God send mi kom tell una evritin wey I tok about dis temple and dis town.


“Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”


Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”


But una make di Nazirite drink wine kon sey make di profets nor prish my message.


Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?


bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”


“Make una go stand for di temple varanda bigin prish God word wey dey give pipol life.”


But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being.


Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!


Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ