4 Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?
Even lions dey kry bikos of honga and dem dey ask God for dia food,
I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west.
I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.
Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”
Two pipol go fit waka togeda, if dem nor gri?
Trap dey fit katch bird, if dem nor use food take set am? Abi trap dey komot from where dem set am put if e nor katch animal?
So na who nor dey fear if lion dey shaut? God wey dey mighty don tok, na who nor go tok about am?