3 Two pipol go fit waka togeda, if dem nor gri?
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.
Dis na Noah story. Noah na pesin wey dey fear God; e nor get fault for body among evry oda human being. E dey waka with di Oga God.
“Out of all di families for di eart, na only una I know and kare for and bikos of dis, I go ponish una for all una sins.”
Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?
Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”