E still skata di altar for Bethel and na Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin, build am. Den e burn all di high place to ashes kon distroy Asherah juju.
Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.
Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”
For where dem for dey woship, dem dey kover diasef with klot wey dem kollect from poor pipol as payment for debts. For inside God temple, dem dey drink wine wey dem kollect from doz wey dey whole dem money.
God sey, “Afta una, Israel pipol don go Bethel go sin for di holy place and woship juju for Gilgal, una go kon sakrifice animals for morning, den for evry three days, una go bring one out of evry ten tins wey una get kom.
Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.
I go distroy all di place where Isaak shidren-shidren for dey woship juju and skata all dia holy place for Israel. Jeroboam shidren-shidren nor go bi king again.”
I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake. “Break dem make e fall for di pipol head. I go kill di remainin pipol for war and nobody go fit eskape.