Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Oga God sey, “Na only few pipol for Samaria go eskape with dia life and with small piece for dia bed and chair. E go bi like wen shepad save two leg and some part of en sheep ear from lion mout.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 3:12
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.


Ben-Hadad tell am, “I go give yu di towns wey my papa kollect from yor papa and yu fit make one place wey yu go for dey sell for Damaskus, just as my papa do for Samaria.” King Ahab ansa, “If na bikos of dis, I go free yu.” E make agriment with am kon let am go.


Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”


Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


Na white and blue curtain wey dem tie with fine purpol linen with silva ring and betta stones, dem take dekorate di kourtyard. Dem put tins wey dem make with gold and silva, for di kourtyard groun wey dem design with white, red, blue and black stones.


As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin. As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?” As di king still dey tok, dem kon kover Haman face.


“I nor go-go my house or go sleep for my bed.


Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem; dem go depend on Israel God wey bi di King of all kings.


True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.


Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”


E go bad well-well for una wey dey relax for una big fine chair kon dey chop betta meat!


Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ