Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 2:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Men wey dey karry bow nor go fit defend demsef; doz wey dey run fast nor go fit eskape and men wey dey on-top horse nor go fit save demsef.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 2:15
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.


‘Wi don distroy Babilon. Wi don seize en sojas kon break dia bow.’ I bi di God wey dey ponish bad pipol and I go pay Babilon back.


Den I go nak en bow komot from en left hand and di arrow wey dey en rite hand.


I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake. “Break dem make e fall for di pipol head. I go kill di remainin pipol for war and nobody go fit eskape.


kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.


Judah pipol go win and mash dia enemies for portor-portor. Wen dem go fight, dem go win dia enemies, bikos mi God dey with dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ