Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But naw, I go distroy una finish and una go kry with pain like truck wey dem ova-load with korn.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 2:13
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E get many korn for di field centre. At wons my korn stand up for di centre and una korn kon bow down for am!”


Yu dey espect am to bring wetin e harvest kon gada am for di place where korn dey?


Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.


I hate una new moon festival and di oda feast wey una dey celebrate, don taya mi. I nor fit bear dem again.


Una neva buy any incense for mi or give mi di fat for una animal as ofrin. Yet una dey wahala mi with una sins kon make mi dey vex bikos of una yeye ways.


So Isaya sey, “Listin naw, una wey bi David shidren-shidren. Even doh e bad to dey try ordinary human being patient, una won try God own too?


“Since yu don forget how I kare for yu wen yu bi small pikin and yu don make bi vex with all di tins wey yu dey do, I must pay yu back for all dis bad tins. But, wetin make yu dey do ashawo join di bad-bad tins wey yu do?” God wey get pawa don tok.


where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do.


Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”


Di ofrin wey dem bring to God na: six truck and twelf melu. One truck na for two leader and one melu for each leader, so dem give dem to God for di Tabanako front.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ