Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 I go kill all di rulers for Ashdod and Ashkelon town. I go ponish Ekron town and Filistia pipol wey remain, go die.” Oga God wey get pawa don tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 1:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Uzzaya attack Filistia pipol kon skata Gat, Jabneh and Ashdod wall. E build towns for Ashdod and all Filistia aria.


Den I for fit kwik distroy dia enemies! My hand for kwik tosh doz wey dey worry dem!


I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.


God give dis message for di year wen King Sargon for Assyria send en kommander go fight and konker Ashdod.


Before Egypt king attack Gaza, God tok to mi about Filistia sey,


But naw, I dey sey I go attack Filistia pipol kon kill all of dem. I go kill evribody wey dey Filistia and nobody go remain.


Tyre, Sidon and Filistia pipol, wetin una dey do mi? Una dey try to pay mi back for wetin I do? If na so, den I go kwik-kwik attack una!


So I go skata Gaza town with fire kon burn all di strong-strong buildings wey dem hide put.


Go tell di pipol wey dey stay for Egypt and Ashdod palis sey, “Make una gada round di hills for Samaria! Make una si di wahala wey dey happen for di town and di bad-bad tins wey dem dey do.”


Jakob shidren-shidren go bi fire; Josef shidren-shidren go bi big smoke and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, dem go burn dem rish groun, bikos God don tok!


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.


Na strenjas go stay for Ashdod town and I go really distroy Filistia pipol, bikos dem too dey karry body up.


Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ