7 So I go skata Gaza town with fire kon burn all di strong-strong buildings wey dem hide put.
E win Filistia pipol for Gaza and di aria wey dey near der; rite from dia gate go rish di towns wey dem guide well-well for der.
Uzzaya attack Filistia pipol kon skata Gat, Jabneh and Ashdod wall. E build towns for Ashdod and all Filistia aria.
Before Egypt king attack Gaza, God tok to mi about Filistia sey,
Bitter wahala don kom meet Gaza pipol and Ashkelon pipol na wen una go stop to kry and pity for unasef?
Wen I don put fire for Egypt and all di sojas wey dey guide am don die finish, den dem go know sey na mi bi God.
“I go set fire put for Magog land and land near di river where pipol dey stay for peace. Den evribody go know sey na mi bi God.
I go send fire kon burn di palis wey King Hazael build. I go burn King Ben-Hadad strong-strong buildings rish groun.
God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.
I go kill all di rulers for Ashdod and Ashkelon town. I go ponish Ekron town and Filistia pipol wey remain, go die.” Oga God wey get pawa don tok.
Dem go distroy Gaza and Ashkelon kon skata Ashdod and Ekron town.
Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”
I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”