15 Dem go karry dia king and en ofisas as slave go anoda land.” Dis na wetin Oga God tok.
Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.
So, bikos una dey curse am, I go give una to anoda kountry wey go tif and skata una. I go distroy una finish, den una go know sey na mi bi God.”