8 So Saul get up from groun, en eye open, but e nor dey si. En friends hold en hand kon escort am enter Damaskus.
So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus.
Di angel kon make di pipol eye blind; from di yong ones go rish di old ones. Den di men for outside kon dey find di door.
God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
Bikos of how di lite shine for my eye, I nor fit si again, so di pipol wey dey follow mi kon whole my hand go Damaskus.
At wons, sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si. E get up and dem baptize am.
E nor si at-all for three days and for dat time, e nor chop or drink anytin.
For Damaskus, King Aretas sey make di govnor put sojas for di town gate, so dat dem go arrest mi.
and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.