Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!
E nor go betta for di pesin wey dey argue with di Pesin wey kreate am! Pesin wey bi like ordinary pot for where oda pots dey for groun. Klay fit tell who dey use am sey, “Wetin yu dey do?” Abi di pot wey yu dey make fit sey, “Yu nor know work at-all?”
Wen wi don fall for groun, I hear one vois wey use Aramaik language tell mi, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi? Yu dey fight yorsef, bikos na stone yu dey kick so.’
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.