40 But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”
Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside