Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 9:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 9:38
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

wi go get all di wood wey yu wont from Lebanon kon arrange dem kom give yu thru Joppa Sea. So yu fit karry dem from der go Jerusalem.”


So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.


But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.


So, send some men go Joppa make dem go koll one man wey en name bi Simon Pita.


and wen e don tell dem evritin wey happen, e kon send dem go Joppa.


Di man tell us how e si angel wey stand for en house kon tell am, ‘Send pipol go Joppa go koll Simon wey dem dey koll Pita.


and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”


“As I dey pray for Joppa I kon si vishon. For inside di vishon, I si sometin wey bi like tray dey kom down small-small from heaven, dem hold am for four korna and e kon stop for my front.


Afta e chop finish, en body kon strong again and Saul kon stay Damaskus for some days with di disciple.


Pita dey travel from one place go anoda and e still go where di bilivers dey for Lydda.


One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.


Wen evribody for Joppa hear dis tin wey happen, many of dem kon bilive Jesus Christ.


Pita kon stay for Joppa for many days with one man wey dem dey koll Simon, wey dey do leda work.


Jarkon wotaside and Rakkon plus di aria for Joppa front.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ