Wen dem enter Jerusalem, dem kon go di room for upstair where dem dey stay. Pita and John; James and Andru; Filip and Tomas; Bartolomew and Matiu; James wey bi Afaeus pikin, Simon wey dem dey koll Zealot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.
So Pita get up follow dem and wen e rish der, dem kon take am go di room for up. All di wimen wey dia husband don die stand near Pita dey kry and dey show am all di dress wey Dorkas make for dem, wen e dey with dem.