Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 9:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Evribody wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, “Dis nor bi di man wey dey kill pipol wey bilive Jesus Christ? Wi tink sey e kom here kon arrest pipol karry go give di priest oga dem.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 9:21
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den I go tish wiked pipol yor ways and dem go turn kom meet Yu.


My life na ezample to many pipol, bikos na Yu bi my strent and proteshon.


Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.


Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”


Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’


All of dem sopraiz and di tin konfuse dem well-well. So dem kon dey ask each oda wetin dis kind tin mean.


Wen pipol hear di nois, dem sopraiz kon gada, bikos evribody dey hear di disciples dey tok with difren language, wey demsef dey tok for dia kountry.


and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.


Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.


As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.”


But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.


But Saul still dey prish with pawa. E dey show sey na Jesus Christ bi di Mezaya and di Jew pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am.


e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una.


Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ