but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.
Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.
Saul happy wen dem dey kill Stefen. Na from dat day trobol start for di church wey dey Jerusalem and all di bilivers kon skata go Judea and Samaria, but na only di apostles nor run.
but di true message about Jesus wey dem kill for cross, naim wi dey prish and di message bi like stone wey Jew pipol kick by mistake kon fall, but to Gentile pipol, na yeye tin e bi.