Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.
So Filip kon dey waka dey go where di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa for Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dia money. E kon woship God for Jerusalem
Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.