But God angel tell Profet Elijah wey kom from Tishbe, “Get up! Go meet di messenjas wey Samaria king send kon tell dem, ‘Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God?
Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.
Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land