Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 8:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 But wen dem bilive di Good News wey Filip prish about God Kingdom and about Jesus Christ, dem kon baptize di pipol wey bilive.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 8:12
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,


Den e kon send dem go prish about God Kingdom and heal pipol wey nor well.


Jesus kon tell am, “Make doz wey don die, beri who don die. But make yu go prish about God Kingdom.”


Na di same apostles e show ensef many time sey, e still dey alive afta di sofa wey e sofa. Dem si am for forty days and e tell dem about God kingdom.


But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ.


Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.


Wen dem hear wetin Paul tok, dem kon baptize dem with Jesus Christ name


Pita ansa dem, “Make una turn from sin kom meet God one-by-one and make dem baptize una with Jesus Christ name, so dat God go forgive una, den una go fit receive di Holy Spirit.


So, dem baptize all of dem wey bilive wetin e prish and dem rish 3,000 pipol wey join dem dat day.


I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.


“Naw, I know sey non of una wey I prish God kingdom give, go si mi again.


kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.


But plenty men and wimen wey bilive Jesus Christ kon join dem,


So di pipol wey skata kon dey go from place to place dey prish di gospel.


If yu bilive and prish with yor heart give pipol sey Jesus Christ na Oga God, God go save yu.


As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body.


E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ.


Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ