David kon give Solomon di plans wey e go take build di temple, di store room, all di oda rooms and di place wey holy pass, where God for dey forgive pipol dia sins.
So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
Dis na di materials wey dem use take build di Tabanako, just as Moses tok. Na Levi pipol do di work and Itama wey bi Aaron pikin, na-im dey show dem wetin dem go do.
For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box.
For di day wen dem build di Tabanako finish, di kloud kon kover di Tabanako and di Kovenant Box and from evening go rish morning, di kloud bi like fire for evriwhere for di Tabanako.
Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”