38 Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.
“Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.
wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.
God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.
E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.
Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!