Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 7:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 Na dis Moses lead dem komot from Egypt. E still do plenty mirakles for Egypt, di Red Sea and inside di wildaness for forty years.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 7:36
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu do wonderful mirakles against Egypt king, en ofisas and dia pipol, bikos Yu know as dem take opress yor pipol. Yu win and give yorsef name wey dem dey celebrate till today.


So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’


God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.


Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.


So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.


So Israel pipol chop manna for forty years until dem rish Kanaan land.


So I go use my hand skata Egypt with all di wonders wey I go do among dem and afta all doz tins, e go let una go.


God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’


So Jesus ask am, “If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”


For forty years, E stay with dem for inside wildaness.


“God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’


For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all.


Make una nor get strong heart for am, bikos na so Israel pipol do wen God test dem for wildaness.


Na for di wildaness una papa for test and try mi for forty years, even doh dem si di mirakles wey I do.


E nor go bi like di kovenant wey I make with dia grand-grand papa dem wen I take dem komot from Egypt, bikos dem break dat kovenant and I kon turn against dem.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ