Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 7:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 “Afta forty years don pass, one angel appear to am for inside wildaness for Mount Sinai, where one bush for dey burn.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 7:30
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Elijah get up kon chop and drink wota again, den di food gi-am pawa to take waka for forty days go di holy mountin for Sinai.


Yu allow men rule us; wi dey pass thru fire and wota, but naw, Yu don bring us kom where dey save.


E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.


Naw, Moses na eighty years while Aaron na eighty-three years wen dem go tok to Fero.


Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


from all dia sofa. Nor bi angel save dem, but na God save dem by ensef. E use en love and mesi take save dem. E dey kare for dem since,


Di offisa, wise men, govnor and ministers wey dey serve di king, gada kon si sey di men wey dem trow for di fire, nor wound at-all! Nor-tin even tosh dia hair or sey dia klot burn. Even di fire sef nor smell for dia body!


“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.


Naw, for di matter about pipol wey go wake-up, una neva read for di book wey Moses rite about di bush wey fire dey burn and how God tell Moses, ‘Na Mi bi Abraham, Isaak and Jakob God?’


But even Moses tok sey pipol wey don die go wake-up. Moses tok like dis wen e rite about how e koll God, ‘Abraham, Isaak and Jakob God’, wen e dey di bush wey dey burn.


“But as time dey near wen God go fulfil di promise wey e make with Abraham; Israel pipol kon dey many inside Egypt,


As Moses si dis tins, e sopraiz well-well and wen e waka near make e si am well, e hear God vois wey sey,


‘Na mi bi di God wey yor grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob dey woship.’ Moses start to shake and fear nor let am look too mush.


“Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.


Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.


Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ