24 Wen e si one man from Egypt dey opress one Israel pesin, Moses kon defend and kill di Egypt man.
Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.
As Moses si sey nobody dey look dem, e attack, kill and beri di Egypt man.
But wen forty years don rish, e kon tink am sey e good make e go visit en own Israel pipol.
E tink sey en own pipol go undastand sey God won use am take save dem, but dem nor undastand.
Hope yu nor won kill mi di way yu kill dat Egypt man yestiday?’