14 Josef send message go give en papa Jakob sey make en and all di pipol wey dey with am kom Egypt and dem bi seventy-five wey go.
So make una tell my papa about all my honor for Egypt and about evritin wey una dey si so. But make una kwik bring my papa kom meet mi for here!”
Judah sons na: Er, Onan, Shelah, Perez and Zera (But Er and Onan die for Kanaan land). Perez sons na Hezron and Hamul.
Den Israel kon go Egypt and Jakob stay as strenja for Ham land.
Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
So, dem baptize all of dem wey bilive wetin e prish and dem rish 3,000 pipol wey join dem dat day.
Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!