I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’
Den dem tell Fero, “Wi just won stay for dis land for sometaim. Wi nor get food for awa animals, bikos of di honga for di whole Kanaan. So wi beg, make yu let wi yor savant stay for Goshen.”