Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 7:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 7:10
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too.


For dis time, na Josef dey rule di kountry and naim dey sell food give all di pipol. Wen en brodas kom meet am, dem bow face groun.


Den Judah ansa Josef, “My oga, abeg make yu let yor savant tok to yu. Abeg make yu nor vex with yor savant, bikos yu just bi like Fero.


di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”


Make Yu forgive dem wen dem sin against Yu kon make dia enemies dey respet dem.


Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa. E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.


God go help and save dem from wiked pipol. E go save dem with en pawa and dem go dey save inside am.


Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.


Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.


If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.


E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.”


And Christ go still save mi from evry evil plan until e take mi enter en kingdom. Make glory bi en own forever and ever. Amen!


Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.


I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ