Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 6:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


Yu go take Levi pipol kom where God dey and Israel pipol go put dia hand for Levi pipol head;


dey beg am sey, “My small dota don nearly die. Make yu kom tosh am, so dat e go well again.”


Den dem kon pray, “Oga God Jesus Christ, na yu know wetin dey inside evribody mind. Make yu show us di pesin wey yu wont among dis two pipol,


Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Saul kon send dem go.


and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.


Pita and John put hand for di pipol head and dem kon receive di Holy Spirit.


I don show am for vishon sey one man wey dem dey koll Ananias go kom meet am and e go put hand for en head, pray for am, make e for fit si again.”


So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”


Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.


Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.


Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.


Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.


wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ