Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 6:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 6:3
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.


E know how to do en work, bikos God don tish am how to work as farmer.


E go give wisdom to doz wey dey judge, so dat dem go judge well. E go give strong heart to doz wey dey defend di town, so dat dem nor go fear any attack.


“Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas.


Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey, di disciple nor go die. But Jesus nor really tell Pita sey di oda disciple nor go die, but e sey, “If I won sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside?”


Di pipol wey dey pray, plenty rish one hundred and twenty. So Pita stand up for di pipol front kon sey,


So, make one pesin from di men wey dey follow us since di time wey Oga God Jesus Christ dey with us,


Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”


Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!


Di brodas wey dey Lystra and Ikonium dey tok good about am.


Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.


One man wey dem dey koll Ananias, wey dey holy and dey serve God akordin to di law and di Jew pipol wey dey stay der, dey tok good about am.


For der, wi si some brodas and dem kon beg us to stay with dem for seven days. Na so wi take rish Rome.


So di twelf apostles gada evribody kon sey, “E nor good make wi leave God word wey wi dey prish kon put hand for food matter.


Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.


Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.


Wen di brodas know about wetin dem dey plan, dem kon take am go Caesaria and from der, dem send am go Tarsus.


Some among us dey fit speak with wisdom and odas with knowledge, but na di same Spirit dey give us all dis gifts.


Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem.


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


Make una choose some men from each tribe wey wise, get wisdom and I go make dem una leaders.’


Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


Pipol don tok about Demetrius, bikos e dey do good and even di trut wey e know, show sey e good. Wisef dey tok about how e good and yu know sey wetin wi dey tok, na true.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ