15 Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.
Na who wise and get sense? Na Who know di ansa to dis problem? Wisdom dey make pesin smile and remove vexnashon from en face.
Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!
Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.
Di priest oga dem kon ask Stefen, “All dis tins wey dem tok about yu so, na true?”
All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.