Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 5:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 5:39
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Laban and Betuel ansa, “Dis na as God wont am. Wetin wi wont nor mean anytin.


Before-before wen Saul still bi awa king, yu lead Israel pipol for war and God promise yu sey yu go rule en pipol and bi dia king.”


‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house.


Na who yu dey trobol and curse like dis? Na who yu dey shaut for and look with bad eye? Na di Holy One for Israel?


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


E nor go betta for di pesin wey dey argue with di Pesin wey kreate am! Pesin wey bi like ordinary pot for where oda pots dey for groun. Klay fit tell who dey use am sey, “Wetin yu dey do?” Abi di pot wey yu dey make fit sey, “Yu nor know work at-all?”


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?”


So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”


But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.


“Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!


So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!


Bikos God foolishness wise pass all di sense wey human being get and God weakness strong pass all di pawa wey dem get.


Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ